The wife I never had episode 4&5

#TheWifeINeverHad
PART 4

On getting back she was awake, we exchanged greetings and she let out series of yawns.

I knew there and then that the yawns were triggered by hunger.

Her : Boo, how far naa ? Where you leave me go this early morning ?

Me : I just stroll go check whether today clean up go get head.

Her : I know when u lie, wetin concern you and clean up, when you start to dey join for clean up?

Me : Haba pesin no go fit do clean up again ?

Her : Boo, e get one babe for this street wey don too eye you, u sure say no be she u go block ?

Me : Habaaa ! No naa ! Sisi which kind yarns be that naa ?

Her : Hahahahahaha ! I’m just pulling your legs abi pesin no fit follow you play ? ( She yawns again)

Me : No naa, e don dey much, u don carry style dey tell me say u no trust Me.

Her : No ooo Bobo, no be so (Yawns again) I just wake up, I no see you, I no come sabi where you put head, na as I hear sound of gate wey dem open, I come see from window as you dey enter. I been dey wonder how u carry waka.

Me : Ok I lied, I went to check Mama Ozioma.

Her : Haba, this early morning ? but She no dey owe us change naa.

Me : I been wan collect somethings on credit, later I go pay am.

Her : But you don’t have to.

Me : See oooo, wetin pesin wan chop, abi you no dey Hungry ?

Her : I dey hungry but I no want make you go dey owe people, especially all these women for street wey dey sabi gossip. Make we just dey, before clean up go (yawns) finish eh, I go don sabi wetin dey.

We both went to brush and after a while, the gates of Hunger were opened in our bellies, I watched her but she kept avoiding my eyes and yawning.

Then some minutes around after 11:00 am, She left the room and was taking long to return, I traced her to the corridor and I stopped dead cold and heart broken as I saw her Licking ToothPaste with tears freely flowing from her eyes.

Me : Chai ! Sisi am so sorry it came to this (I quickly took her into my embrace).

Her : (Sobbing) I’m so sorry, I’m so hungry and I’m trying out an old trick in my secondary school boarding house days of keeping hunger at bay with toothpaste.

I was so heart broken that I left her and dashed towards Mama Ozioma’s Kiosk ready to Beg her for bread on credit even if it meant being gossiped with.
TBC

#TheWifeINeverHad
PART 5

As I rushed out of the gate and crossed the road, A Peugeot 505 salon car was approaching with its horn blaring and headlamps flashing as it drove toward my direction.

I shifted to allow it pass but it came to a halt beside me and the two occupants happened to be my friends James and Chidolue.

James : (Excited) Abobby eeeeee !!!!

Chiddolue : (Excited as well) Oh Boy where u dey put head ?

Me : (Letting out a faint smile) Mehn I dey go buy something for down the street.

James : we been dey come see you, as we don see you enter motor naa, make we kukuma buy fuel for junction.

I entered and we drove to a petrol station at the junction.

After refuelling the car, James announced that he was hungry and needed to eat at the cafeteria opposite the petrol station.

As we got there, he ordered Garri and vegetable soup and subsequently asked us to make orders for ours as well, Chidolue asked for Semo and Egusi, while I whispered into James’s ear that I needed the money meant for my own plate of food.

He still insisted that I ate.
I gladly ordered Fufu and vegetable soup.

I munched away hungrily that being the last to order I became the first to finish, James sensing how hungry I was requested that I took extra which I gladly did.

It was a Miracle to be given such a treat, but for every ball of fufu I ingested, my mind went back to my hungry girlfriend who was in my room starving, I was enveloped with guilt.
But it was a miracle I couldn’t resist.

After the meal, James promptly foot the bills and I called him aside and spoke to him.

Me : Abobby, thank you very much, u just saved a starving man

James : hahahahahaha ! Dis man sef, notin do u.

Me : Abobby, I dey broke scatter and the only help wey you go offer me now na to help me with transport make I run go house, even my babe sef dey room, shishi no gum both of us, we never chop, as una meet me eh, na credit bread I dey go collect. That time.

At that point his phone rang and he excused himself to answer the call.
That call indicated that they were to be heading to somewhere from that point.
James : (Opening his wallet, brought out N1000 and handed over to me) Abobby Hol dis one naa.

My eyes nearly popped out of my eyeballs.

Me : Abobby! Abobby !! Abobby !!! (I screamed with glee)

James : (Laughing) abeg enter motor make we drop you, Chido reverse make we go drop am before we go waka dey go.

Chidolue : I no sabi wetin una dey come go do two aside for oooo, make una no sell me oooo

We all laughed, boarded the car and sped off towards my house.
TBC

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *